Google ads

Monday 4 May 2015

Some Hilarious Urhobo Proverbs

Hi everyone,i'm Urhobo and my Urhobo friend on
Facebook shares these proverbs on his wall,i
loved them and thought to share with
everyone,you dont need to be Urhobo to
understand them though since they are in
English. Enjoy!


*I no wan die naim make person dey drink
medicine wey bitter
*Pikin and papa nor dey measure size of joystick
*Head wey big,na neck dey suffer the
consequence
*Na only look fowl dey look groundnut wey dey
inside bottle
*Husband nor dey go in-law farm go by mistake
go cut joystick
*Instead make bad tin happen,make rain fall
*Person no dey drink ogogoro dey smile
*Friendship no fit rabbit and hare
*Before person go roast plantain,roast yam
finish,e hand must to black
*Man wey dey dance hard dance,na hin brokos e
dey wahala
*Who yansh pepper no dey eat richman money
*Na wetin hoe dey do for farmer naim make am
dey always carry am for shoulder
*Person wey show ripe palm fruit(banga) give
old man naim dey help am harvest am
*Pikin wey witch/wizard send message no dey
fear
*I no go fit climb,na for ground person dey talk
am
*Person no dey straff(have s.ex) dey hiss
*Money dey sweet but e nr dey bring out oil
*If e better for hawk for up, e for no come down
dey come carry small fowl
*Animal wey oba wan kill,na so so neck e dey for
fat
*Who dey owe you money dey use style dey help
you dey save am
*When you dash person goat,you go comot hand
from the rope wey you take tie the goat
*Na hunger dey make person eat wizard food
*Mature woman nor dey fear joystick
*Na see i see am pick naim small pikin dey take
enter stealing
*Animal wey get pikin no dey hard to catch
*If madman no harsh,small children go dey use
stone stone am
*E never better for people wey dem pray for
finish,na come be the ones wey dem swear for?
*No be small thing woman bosom see before e
begin look down
*If who dey front no lost,who dey follow am no
dey lost
*Who call you human being naim you dey call
human being
*Wetin dey find blood,even if them give am palm
oil,e nor go take
*Wetin pursue madman from inside hut for farm
strong pass the madman
*I no gree naim dey tear cloth
*Na another person head fit to break coconut
*Who bend down dey look another person
yansh,somebody else stand jeje for im back dey
look im yansh
*No be small thing night see before day break
*Who dey beg for something na hin hand dey
long pass
*Where person dey go and e wan sleep there,e
no dey hurry
*Na short goat legs just short,if not goat na big
animal
*Who dem carry for back nor dey carry another
person
*Who wan born pikin must to Unclad
*When your person dey on top of orange,you no
dey lick unripe one
*Na early morning person dey hurry
Feel free to add yours,which is your favourite?

No comments: